Roforofo Fight - Fela Kuti

Fela Kuti

专辑:《Roforofo Fight (Explicit)》

更新时间:2025-04-12 18:50:42

文件格式:mp3

网盘下载

Roforofo Fight - Fela Kuti 其他版本
Roforofo Fight - Fela Kuti 歌词

Roforofo fight...

From Abeokuta city

Translation to original English:

She tear pata, he tear buba

She tear pata, he tear buba

She tear trouser, he tear pant

She tear trouser, he tear pant

She pull the thing commot, he tear the thing

She pull the thing commot, he tear the thing

All don scatter

From Abeokuta city

Get away

F**k off

Who are you?

Go and die

F**k away

Get away

Who are you?

Go and shit

You dey craze

I no craze

F**k away

Who are you, eh?

Na two people dey yab so

Na two people dey yab so

Where them dey yab, roforofo dey

Where them dey yab, roforofo dey

Now listen to me now now

Huh!

Two people dey yab

Crowd dey look

Roforofo dey

Two people dey yab

Crowd dey look

Roforofo dey

Wetin you go see?

Roforofo fight eh

Wetin you go hear?

Roforofo fight eh

If you dey among the crowd wey dey look

If you yourself

You yourself dey among the crowd wey dey look

And your friend

Your friend dey among the two wey dey yab

Tell am, tell am, tell am, tell am

Tell am make him no fight o

Make him no fight

Make him no fight because Roforofo dey

Your friend him don vex

Him don vex patapata, him no go hear

Your friend him don vex

Him don vex patapata, him no go hear

By and by

By and by the fight go start

By and by

By and by them go fall for roforofo o

Them face go be roforofo face

Them yansh go be roforofo yansh

Them body go be roforofo body

You no go know

You no go know who your friend be

You no go fit help your friend

Just because roforofo dey

If you wan help your friend

Roforofo go rub for your face

If you wan help your friend

Roforofo go rub for your yansh

You go tell am make him no vex

You don tell am before make him no fight o

Make him no fight

Make him no fight because roforofo dey

Now listen to me now now now now

Huh!

Roforofo don change them

Them go look like twins

You no go know who be who

Roforofo don change them

Them go look like twins

You no go know who be who

You no go know your friend from who

You don tell am before

Make him no fight o

Roforofo dey for there

Two people dey yab

Crowd dey look

Roforofo dey

Wetin you go see?

Roforofo fight eh

Wetin you go hear?

Roforofo fight eh